Mason Greenwood talk say 🔴⤵️
Make I start by yarn say I sabi say pipo go judge me sake of wetin dem see and hear for social media, and I know say dem go think say e bad pass.
I grow up sabi say violence or abuse for any relationship no dey right. I no do the things wey dem accuse me of, and for February dem clear me of all di charges.
But e sure me say I nack correct yansh for my relationship, and I dey accept my share of responsibility for di yama yama wey carry us reach where social media post show.
I dey learn to sabi my responsibility to show good example as professional baller, and I dey focus on the big big responsibility wey papa and good partner be.
Today decision no be only my own, na everybody wey dey Manchester United, my family and me take do am together. The best decision for all of us, na make I waka comot from Old Trafford, so dat my presence no go cause any wahala for the club. I hail the club for the support wey dem give me since when I be small pikin of seven. United go always dey part of me.
I thank my family and all my pipo wey dey show me love for their support, and e dey up to me now to show say I fit repay the trust wey dem show me. I wan be better baller, but pass that one, I wan be better papa, better person, and use my talent for positive things both for field and off field.
Dem talk say Al Ahli don dey discuss to sign Rodrigo de Paul. The talks dey on ✅🆙.
This Ronaldo move go Saudi Arabia 🇸🇦, ehn, e big no be small. Even some pipo wey we think say dem go enter MLS sef fit dey consider am.
E be like say the matter wey concern Rodrigo de Paul don scatter. Al Ahli wan focus on their main midfield target afta dem stop €32m negotiation for Monday night ⛔️🇦🇷🇸🇦.
De Paul sef dey ready to stay for ATM and ginger fight for hin club afta e follow Diego Simeone yan.
Una sure say Sergio Aguero no dey behind him decision? abi wetin una think wey make am take U-turn.🤔🤔🤔
Tags
MASON GREENWOOD